God no go shame us is the first episode from the series "Real talk"
Lyrics
My guy make I tell you something
God no go shame us
Him no go even allow the hustle make e kill us
Truth be say, this life no balance
With all d hustle na zero still be the account balance
This struggle dey real o
I understand say plenty people dey depend on your success
Some they trend ur matter as if you owe them like access
Popsy dey sick, them they wait make you send cash
Momsy dey house dey brag say him pikin go soon buy benz
If you fail them go laugh you,
You comut leave house so u go dey send something go house
Every morning you dey pray make God no shame you, make him just bless this hustle
Deep inside you dey wonder when the hustle go
Me I believe say, God no go shame us
Him dey see all our struggles
That prayer wey momsy been pray for you , e be things o
This thing na just time, God no go shame you
But when God bless you, I hope say you sef no go shame God
All our hope, na on God
Me I believe say, God no go shame us, I dey pray say we sef, we no go shame God
Category
Show more
Comments - 25
Related videos for Barnz Agev GodNoGoShameUs RealTalkSeries: